Mr. Grammarticalogylisationalism Is the Boss
Fela Kuti
Now listen to me now
My brothers and sisters
I beg you now listen to me now
Oh now listen to me now
My brothers and sisters
I beg you now listen to me now
They na be man
(Which man?)
Wey talk oyinbo well well to rule our land o
(That man!)
Oh yes
[Chorus]
Him talk oyinbo pass English man!
Him talk oyinbo pass America man
Him talk oyinbo pass French man
Me I say him talk oyinbo pass Germany man
The better oyinbo you talk
The more bread you go get
School start na grade four bread
B.A. na grade three bread
M.A. na grade two bread
Ph.D na grade one bread
The better oyinbo you talk
The more bread you go get
They na be man
(Which man?)
Wey talk oyinbo well well to rule our land o
(That man!)
[Chorus]
Him talk oyinbo pass English man!
Oh yes
Him talk oyinbo pass America man
Hear it!
One more time
First thing for early morning
Na newspaper dem give us read
First thing for early morning
Na newspaper dem give us read
The oyinbo wey dey inside
Petty trader no fit to know
The oyinbo wey dey inside
Market woman no fit to read
The oyinbo wey dey inside
Na riddle for laborer man
Inside the paper
Lambastical dey
Inside the paper
Ipso facto, dey that one na Latin
Inside the paper
Jargonism dey
Inside the paper
Youth delinquency dey
Who be deliquent?
Na dem be deliquent
Who be delinquent?
The oyinbo talker delinquent
Who be delinquent?
It no be me o
They na be man
(Which man?)
Wey talk oyinbo well well to rule our land o
(That man!)
Oh yes
[Chorus]
Him talk oyinbo pass English man!
Him talk oyinbo pass America man
[Fela makes up some gibberish oyinbo]
Him talk oyinbo pass Germany man
Me I say him talk oyinbo pass French man
Share
More from Fela Kuti
Go Slow
Fela Kuti
O.D.O.O. (Overtake Don Overtake Overtake)
Fela Kuti
Roforofo Fight
Fela Kuti
Opposite People
Fela Kuti
Shakara (Oloje)
Fela Kuti
Army Arrangement
Fela Kuti
Fear Not for Man
Fela Kuti
V.I.P. (Vagabonds in Power)
Fela Kuti
Authority Stealing
Fela Kuti
No Agreement
Fela Kuti
Unknown Soldier
Fela Kuti
I.T.T. (International Thief Thief)
Fela Kuti
Shuffering and Shmiling
Fela Kuti
Sorrow, Tears, and Blood
Fela Kuti
Dog Eat Dog [Instrumental]
Fela Kuti
[Untitled Instrumental]
Fela Kuti
Palm Wine Sound [Instrumental]
Fela Kuti
Zombie
Fela Kuti
Mr. Follow Follow
Fela Kuti
Authority Stealing, Pts. 1 & 2
Fela Kuti